3 Places to Buy Cheap Thrift in Enugu Wey Students No Dey Talk About
If you dey find where to buy cheap and clean thrift for Enugu, forget Polo Park for now. Polo don cost.
Here are 3 hidden places:
1. Ogige Market, Nsukka
If you be UNN student, this na your headquarters. On Wednesday market day, bale dey open by 6am. You fit get quality vintage polo for 2k, jean for 3k. Go early before resellers pack am.
2. Ogbete Main Market - Behind New Layout
Enter inside main market, ask for second hand line. For that back side, mama dem dey sell okrika wey still get tag. Hoodie 2,500, shirt jacket 3k. Price am well, no show say you like am too much.
3. Holy Ghost / Old Park Night Market
For night around 7pm, boys dey bring bale comot for ground. This na where you go see designer thrift - Zara, H&M, Nike tee for 1,500 to 2k. Come with torch and check well because some get small tear.
How to wash your thrift make e look new:
Soak for hot water with small parazone for 10 minutes, wash with sunlight, iron well. No body go know say na okrika.
Enugu thrift na survival skill for students.
You must be logged in to post a comment.