Tragedy don happen for Taraba State as gunmen kill 58 people for market day attack.
According to police report today October 26, the attack happen for Binnari community for Karim-Lamido Local Government Area.
Police spokesman, Victor Mshelizah, confirm say death toll rise to 58 after dem recover 15 more bodies from bush and river today Sunday.
Wetin Happen?
The gunmen enter the community on Friday wey be their market day. Dem shoot anyhow for 4 hours, burn houses, and pursue people comot.
Police say many people run enter bush, some enter canoe to escape but the canoe capsize for river.
Some bodies dem see for river, some for bush. Many people still dey missing as rescue operation dey go on.
Taraba State government don talk say dem don start to share relief materials to families wey survive.
No group don claim responsibility yet.
Residents don dey beg government to send more security.
You must be logged in to post a comment.