*1. Dem dey wait for big money*
Many people no wan start because the money small. Dem want N100k at once. But small money na im dey grow become big money. If you fit make N500 today, you fit make N5000 tomorrow.
*2. Dem dey shame to post*
Dem dey shame to post their hustle for WhatsApp status. But the same people wey dey shame na dem go still borrow money tomorrow. No shame for hustle. Post your work, make people see am.
*3. Dem dey start today, dem quit tomorrow*
Dem go write 1 article, nobody read am, dem go vex quit. But money for phone na like farming, you go plant today, you go harvest later. If you stop, you no go harvest anything.
My own advice be this: Start small, no shame, no quit quick.
I still dey write my 1 article per day for Lodpost, I dey share am for WhatsApp and Facebook. E dey small small, but e dey enter.
Which one among these 3 na your own problem? Talk true for comment, make we correct am t
ogether.
---
You must be logged in to post a comment.