★How I made 100k in one week 💯★
I be Imo boy. I no be PH boy, make we clear am first. If you call me PH boy again, I go report you to my village people for Owerri.
I come PH come hustle, but my OPay balance na the real comedy. Anytime I open am, e dey tell me "Hi Hi Hi" - like say e dey laugh me.
My OPay no dey ever get alert wey pass ₦500. If ₦1,000 enter, I go do thanksgiving. My friends go think say I don blow.
So I start to find how boys dey make money with phone for Naija. And na wetin I find be this:
First, I go try those games wey dey Facebook. Dem go tell you "You don win ₦90,000, just pay ₦2,000 to unlock am." My brother, I no pay. Na my data I take play the game, dem still want collect my money? Na scam.
Second, I go try one app wey dem say e dey pay direct to OPay. Na Hawkit. That one no be scam. E no go make you rich, but at least e dey pay. You do small task like follow person for Instagram, comment, you go see ₦100, ₦200 enter. E small, but e better pass zero. I fit withdraw ₦100 sef, no wahala.
Third, na this Lodpost wey you dey read now. Dem say if people read your article, dem go pay you. So I say make I write my own wahala make una read am. If you dey read this one now, you don already help my OPay. God go bless you.
Make I tell you truth wey nobody go tell you for TikTok: No app go pay you ₦10k daily direct to OPay. If e easy like that, everybody for Owerri and PH for don be millionaire. All those "₦5,000 don land" videos na acting. Na dem dem dey use your data chop money.
But if you combine small small, e go enter.
Morning: Do 2 Hawkit tasks.
Evening: Write 1 Lodpost article like this one.
Night: Pray make your village people no block your blessing.
If you be Imo boy or PH boy wey your OPay dey cry like my own, comment "Hi Hi Hi" for comment section make I know say I no dey alone.
And abeg, share this article to your WhatsApp status. No be for me, na for your own OPay future. Because if my article blow reach 10,000 views, I go buy data for myself and I no go dey disturb you again.
We move,And keep hustling 😎
You must be logged in to post a comment.