5 Side Hustles Wey Sapele Girls Dey Use Make Money for Night After Work (No be Bad Thing)

Follow
Listen to Article Listen to this article read aloud

Audio uses the voice available in your browser or device.

For Sapele here, many girls dey work for day but for night dem still dey hustle extra money. No be bad thing o, na legit hustle. I dey do some of them sef after my shop close.

 

1. Hala Live Hosting for Night (7pm - 10pm)

After work, you fit go live for Hala App. You dey gist, play music, sell GoJelly or hair. People dey send gift and you dey change gift to money. Na wetin I dey do for Room 4508015. Night time na when people free to watch.

 

2. Writing for Lodpost.com

Like wetin I dey do now. You write article about Sapele life with your phone for night. Lodpost dey pay you when people read am. No capital needed.

 

3. Selling GoJelly and Small Chops for Night

For night for Sapele main road, workers wey close for work dey hungry. If you fry puff puff, buns, GoJelly, you fit make 2k to 3k for night.

 

4. Charging Phone Business

When NEPA take light, you fit charge phone for people for 100 naira per phone if you get small gen. For my area for night, people dey queue.

 

5. Making Hair for Students

Sabi make hair? For night after work, you fit make hair for students for house. One hair na 1k or 1500. Two heads for night na better money.

 

For Sapele, money dey for night if you no lazy. Try one of these 5. Start with phone wey dey your hand.

More Articles by This Writer

Support the Writer

Enjoyed this article? You can support the writer with a voluntary donation.

Your donation supports Samsonbella Gold

Minimum donation: $2.00   •   90% of the donation is allocated to the writer after the LodPost commission.

Comments

You must be logged in to post a comment.

About Author

0 Followers
0 Following
5 Articles
0 Likes