How I Dey Make Money From Trading Food For House Everyday

Follow
Listen to Article Listen to this article read aloud

Audio uses the voice available in your browser or device.

How I Started Selling Foodstuffs From Home With Small Capital

Na how I dey do am be this. You no need to wait until you get big money before you start a small foodstuff business. If you get space for your house, you fit start small and grow your business gradually.

1. I Dey Buy Small Small

I no dey wait till I get big money. I dey buy small rice, small garri, small beans. When e finish, I buy again. Small small dey turn big.

2. I Dey Sell Wetin People Must Chop

I no dey sell wetin people no need. I dey sell rice, garri, beans, yam, plantain and noodles. Na food wey every house must buy.

3. I Dey Sell for My Compound and Street

My customers na my neighbours, my church people and people for my street. I no need to go far market before I fit find customers.

4. I Dey Give Small Measurement Wey People Fit Afford

Some people no get money for big bag. I dey sell in small cups and small rubber. Na that one dey make them come back every day.

5. I Dey Keep My Profit Separate

When I sell, I dey remove my profit keep am one side. I no dey chop all the money. Na that profit I dey use buy more goods and grow the business.

My Advice

If you get house, you get shop. Start with wetin you get. Sell wetin people dey chop every day, and your money fit dey come small small as your business grows.

You no need to start big. Start with the little you can afford, treat your customers well and manage your money carefully.

You dey trade food for house too? Tell me for comment wetin you dey sell.

More Articles by This Writer

Support the Writer

Enjoyed this article? You can support the writer with a voluntary donation.

Your donation supports Chibueze Ezekiel Samuel

Minimum donation: $2.00   •   70% of the donation is allocated to the writer after the LodPost commission.

Donate by Nigerian Bank Transfer

Send your donation in Nigerian Naira (₦). Your receipt will be reviewed by the LodPost admin before your donation is credited.

₦
Minimum donation: ₦100.00

How it works: Transfer the donation to the account above, upload your payment receipt, and our admin will verify and credit the writer.

Comments

You must be logged in to post a comment.

About Author

2 Followers
0 Following
16 Articles
5 Likes
Related Articles