I am a student in Benin and data dey cost. I was spending almost N5000 to N7500 every month for MTN data until I found these 5 legit ways wey dey work for me in 2026. No be hack or VPN, na real MTN bonus.
1. Use MyMTN App Every Day
If you never download MyMTN app, you dey lose. Open the app every morning, click on "Deals" or "Offer". MTN dey give daily free data like 50MB to 200MB just for logging in. Last week I got 500MB free because I checked in for 7 days straight. Just download am from Playstore.
2. MTN Double Data Offer
Dial _312#. If your line is eligible, you go see "Double Data". When you buy 1GB for N600, dem go give you extra 1GB free. That means 2GB for N600. Not all SIM get am, but try your old MTN SIM, e dey work more for old numbers. My 2 years old SIM get am.
3. MTN Night Plan Still The Best
For we students wey dey press phone for night, this one save me. Dial _406_3# and choose Night Plan. N250 for 1GB from 11pm to 6am. If you get small night work or you wan download film, na there e cheap pass. I dey subscribe am every night for my assignment download.
4. Buy From SME Resellers Instead of Direct
Instead of buying _312* directly, buy from data resellers on WhatsApp. Dem sell 1GB for N400 to N500 instead of N600. I dey buy from one guy for Ekosodin, e dey send am in 5 minutes. Search "MTN SME data vendor" for WhatsApp, but make sure na person wey your friend know so you no go lose money.
5. MTN Welcome Back Bonus
If you get MTN SIM wey you never use for 1 month, put am back for your phone then dail *312# mtn to do you welcome back then come bless you with 2gb for 7 days. Me I get 2 sims so I de interchange it.
You must be logged in to post a comment.