MR A:All my brother senior me with 2yrs but na de same day Dem born us
MR B:If I de travel for plane I de open the glass for fresh air
MR A:I go heaven with my Iphone snap picture with angel
MR B: Mosquito wey bite me last 4yrs,I kill am yesterday
MR A:Na inside fridge my papa de park his car
MR B: Motor jamb me remove my head but thank God I survived
MR A:If my phone off I go still de recieve call
MR B:Na spit my papa de use bless us
MR A: My army brother wey join army de use one gunshot clean his ear
MR B: For our village rain no de fall cus we don use cement plaster the sky
MR A:For our house we get 2 swimming pool but thief come collect one
MR B: Swimming pool wey dey our house na for air Dem dig am
MR A:My uncle snap passport,but his leg de show
MR B:I tell my mama say my head de pain me she come buy me new head
MR A: Yesterday I de hungry I come send my shadow may e go buy food for me
MR B:My pastor de use avatar state talk to God
MR A:Since I was born na my sweat I de use bath
You must be logged in to post a comment.