For beginning, I no get money to pay for advert. I no fit pay Facebook advert, I no fit pay influencer. The only thing I get na my phone and my WhatsApp status.
At first, I dey shame to post. I dey think say people go talk say, "This one don turn to seller." But I later understand say, if I no post, nobody go know wetin I dey sell.
So na so I start to use my status well:
*1. I Post Every Morning*
Every morning before 8am, I post wetin I sell. I no miss day. People wey dey view my status for morning, dem dey see am first. Na consistency be the secret.
*2. I Post Clear Photo and Price*
I no dey post blurry photo. I dey take clear photo, I put price on top. When customer see price, e easy for am to decide. If you hide price, customer go waka pass.
*3. I Post Customer Testimony*
When person buy from me and happy, I go beg am make e allow me post am. I go screenshot wetin dem talk, I post am. New people go see am, dem go trust me more.
*4. I No Dey Post Only Selling, Selling*
Sometimes I dey post my story, my wahala, my small win. People dey like to buy from person wey dem know, no be only seller. Na why my Day 2, Day 3, Day 4 stories dey work.
One day, one person wey never talk to me before, just chat me, "Abeg you still get that thing wey you post yesterday?" Na so she buy am. She don dey view my status for weeks, she just dey watch.
*Lesson Wey I Learn:*
Your WhatsApp status na your free shop. If you no post, your shop dey closed. Post everyday, post clear, post with price.
If you get phone and WhatsApp, you get shop already. Use am well.
You must be logged in to post a comment.